20 For der, e build one altar kon name am, “Na Israel God bi God.”
So Abram karry en tent kon go stay near Mamre oak wey dey Hebron and e build anoda altar for God for der.
Den Abraham plant tamarisk tree for Beersheba and e woship di Oga God wey bi di God forever for der.
Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
Den e buy di field where e bin build en tent put; E buy am from Hamor pikin wey bi Shekem papa for one hundred silva.
Dinah wey bi Leah dota wey e born for Jakob go visit di wimen for di land.
E build one altar for der kon koll am El Bethel (wey mean God house), bikos na for der God for show ensef to am wen e dey run from en broda.
Noah build one altar for Oga God. E kon take some from evry klean animal and bird take offa ofrin for di altar.
For der wey all di pipol gada put, David praiz God kon sey, “God wey awa papa Jakob serve, wi praiz yor name forever!
Awa papa dem serve God for dis mountin, but una kon tok sey, di place wey pipol suppose to woship God, na Jerusalem e dey.”