So, abeg, make yu take all dis present wey I bring kon give yu, bikos God dey good to mi and I get evritin wey I wont.” Wen Jakob beg am well-well, e kon take dem.
Jakob kon tell Esau, “My oga, yu know sey di shidren still small and I dey kare for di animals wey just born, if wi sey make wi travel with dem for just one day, all di animals fit die.