9 Jakob kon sey, “My papa Abraham and Isaak God, di Oga God wey tell mi sey, ‘Make yu go back to yor kountry and yor family, so dat I go do good for yu,’
den Oga God stand for di top. God kon sey, “Na mi bi di Oga God, yor grand-papa Abraham and yor papa Isaak God. Dis groun wey yu sleep put so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.
Bikos na mi bi di God wey dey for Bethel, di place where yu for anoint stone kon make vow. Naw, make yu get up komot from dis land, den go back go meet yor pipol.’ ”
If I won wound yu, I go fit do am. But yor papa God tell mi yestiday nite for dream sey, ‘Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.’
If my papa God, Abraham God and di Pesin wey Isaak dey fear nor dey with mi, true-true yu for porshu mi go without anytin. God si my mind and di work wey I dey do with my hand, naim make am tok to yu yestiday nite.”
una papa God wey go help una, di God wey get pawa wey go bless una with di blessing wey dey di sky for up; di Pesin wey get blessings wey dey wota and under di eart and even di ones from animals.
Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”
kon pray: “My Oga wey bi awa grand-grand papa God, na Yu bi God wey dey for heaven and na Yu dey rule di whole world. Na Yu get all pawa and nobody fit stand against Yu.
David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.