Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 32:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Den Jakob kon dey fear and en mind nor setol. E divide both di pipol wey dey with am and di animals into two group,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 32:7
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Abeg, make Yu save mi from Esau my broda; bikos I dey fear sey e fit kom attack mi, my wifes and my shidren.


Jakob send message go meet en broda Esau for Seir wey dey for Edom land


bikos e tink sey, “If Esau kom attack one group, den di oda group for di oda side go run.”


Jakob look up kon si Esau dey kom with 400 men. So e kon divide di shidren among Leah, Rashel and en two savant.


Naw, make wi dey go Bethel. Den I go build altar for God wey dey ansa mi wen I dey trobol and E always dey with mi for anywhere wey I dey go.”


so dem kry as dem dey trobol sey, “Awa God, make Yu kom help us!” So God save dem from dia trobol.


Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.


I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi.


I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear. My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.


From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.


Israel pipol look up kon si Fero and Egypt sojas dey mash kom meet dem. Fear katch dem, so dem shaut kon kry to God.


Di sense and undastandin wey yu go get, go protet yu.


E know how to do en work, bikos God don tish am how to work as farmer.


“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.


“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”


Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”


E dey help us wen wi dey trobol, so dat wi go fit help odas thru di help wey E help us.


True-true, anybody wey won live di kind life wey God wont inside Christ, make e know sey e must sofa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ