God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.
Di Oga wey bi Israel pipol God wey dey holy; di Pesin wey dey make awa future betta, don sey, “Yu nor get rite to kweshon mi about my shidren or tell mi wetin I go do!