“E still get Shimei wey bi Gera pikin, wey kom from Bahurim town for Benjamin tribe. E curse mi well-well di day wey I go Mahanaim, but wen e si mi for Jordan River, I use God name take promise am sey I nor go kill-am.
Den Elisha kon pray, “Oga God, make Yu open my savant eye, so dat e go si for ensef.” So God open di savant eye, so e kon si sey many horse with fire kover di mountins wey surround Elisha.
Make yu kom back. Abeg! Make yu kwik kom back, so dat wi go fit si and look yor face again! Why una wont make dis Shullam woman dance Mahanaim style with di odas?