For di time wen animals dey sleep with each oda, I look kon si for dream sey di goats wey dey sleep with di oda animals, get mark, spot and dem dey black.
So, abeg, make yu take all dis present wey I bring kon give yu, bikos God dey good to mi and I get evritin wey I wont.” Wen Jakob beg am well-well, e kon take dem.
Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.
Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.
E get one man for Maon and e dey sell for Karmel town. Dis man get money well-well; e get 3,000 sheep and 1,000 goats. Dat time, e dey barb en sheep hair for Karmel.