Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 32:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Yu bin sey, ‘I go really do good for yu kon make yor shidren plenty like san-san wey nobody fit kount.’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 32:12
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.


Leta, di messenja kom back kon tell Jakob sey, “Wi go meet yor broda Esau and E dey kom meet yu and 400 men dey with am.”


Israel and Judah pipol plenty like san-san for wotaside; dem get enough food to chop and drink and dem dey happy.


Make Yu remember Abraham, Isaak and Israel yor savants wey Yu promise sey, ‘I go make una shidren-shidren plenty like di stars for sky and all dis land wey I don tok about, I go give dem to una shidren-shidren and dem go stay der forever.’ ”


But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”


God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.


Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.


Weda wi get faith for am or not, Christ go still bi who e bi and e nor go shange.


Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.


So from dis one man wey en body don die finish, shidren wey plenty rish stars for sky and san for wotaside kon full evriwhere.


So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.


God wey get Israel must do wetin E tok and E nor dey shange en mind, bikos E nor bi human being wey dey shange mind.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ