35 Den Rashel tell en papa, “Make my oga nor vex sey I nor fit stand, bikos I dey si my period.” So e look evriwhere and e nor si di gods.
As Laban go kare for en sheep, Rashel kon tif en papa gods for di house.
Naw, Rashel don take di gods kon put dem for kamel den e sidan put. Laban look evriwhere for di tent, but e nor si dem.
Den Jakob kon dey vex well-well for Laban sey, “Na wetin I do? Na wish sin I kommit wey make yu porshu mi like dis?
Batsheba go meet di king, make e for tell am wetin Adonijah tok. Di king stand up, bow greet en mama, den e sidan for en throne kon bring anoda chair for en mama make e for sidan for en rite side.
Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.
“ ‘Wen woman dey mestrate, e go dey unklean for seven days. Anybody wey tosh am go dey unklean till evening.
Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.
Make una dey respet and honor pipol wey senior una. Make una fear una God; Na mi bi God.
Shidren, as una know God, make una dey hear una papa and mama word, bikos na wetin una suppose do bi dat.
Una wey bi slave, make una dey obey una oga, both di ones wey good or gentol and doz wey nor good.
As Sarah obey Abraham kon koll am, “My oga,” una go bi God pikin, if una dey do wetin good.