27 Why yu play wayo run kon deceive mi? But yu for tell mi, so dat I go free yu with good mind kon play instrument and sing betta song for yu.
So Laban tell Jakob, “Wetin make yu just deceive mi kon karry my dotas dey go like pipol wey dem katch with swod?
Jakob ansa Laban, “Na fear kause am, bikos I tink sey yu go take yor shidren from mi with force.
En broda name na Jubal and e dey among doz wey first play di harp and flute.
Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.
Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do,
So Gideon take ten among en savant follow body go do wetin God tok. But e do am for nite, bikos e dey fear en family and di pipol for di town.