Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 31:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 So Laban tell Jakob, “Wetin make yu just deceive mi kon karry my dotas dey go like pipol wey dem katch with swod?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 31:26
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Fero koll Abram kon sey, “Wetin bi dis wey yu don do so? Why yu nor tell mi sey dis woman na yor wife?


Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.


Den di king sey, “Wetin make yu do us like dis? Wot of if one of my men kon go sleep with yor wife? Den yu for don make us sin!”


For morning, Jakob kon find out sey na Leah e sleep with! So Jakob tell Laban, “Wetin yu do mi so! Nor bi bikos of Rashel make mi work for yu? Wetin make yu deceive mi?”


Den Oga God tell di woman. “Wetin bi dis wey yu don do so?” Di woman ansa, “Di snake deceive mi and I kon chop from am.”


All di money and propaty wey God don take from awa papa hand, na wi and awa shidren get dem.”


Laban meet Jakob for where e dey. Naw Jakob don build tent for di hill and Laban and en men still build tent for dat aria too.


Why yu play wayo run kon deceive mi? But yu for tell mi, so dat I go free yu with good mind kon play instrument and sing betta song for yu.


Den Jakob kon dey vex well-well for Laban sey, “Na wetin I do? Na wish sin I kommit wey make yu porshu mi like dis?


All dia propaty, dia shidren and dia wifes, dem katch dem kon skata der.


But di Oga God sey, “Wetin yu don do so? Yor broda blood dey kry from groun kon meet mi!


Pilate kon sey, “Yu know sey I nor bi Jew, abi? Na yor pipol and priest oga dem bring yu kom meet mi. Wetin yu do sef?”


So Joshua kon tell Akan, “My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive mi at-all!”


So Saul tell Jonatan, “Tell mi wetin yu do.” Jonatan kon tell am, “I use my rod take taste small for di honey. I must die!”


David ansa am, “Wetin I don do naw? I nor go fit tok anytin again?”


Dem katch di wimen wey dey der, from di small ones go rish di old ones, but dem nor kill anybody. Dem just karry dem follow body.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ