25 Laban meet Jakob for where e dey. Naw Jakob don build tent for di hill and Laban and en men still build tent for dat aria too.
Den e komot from der go di hill kountry for Bethel for east kon stay der. E build anoda altar for der for God kon woship am.
But God kom meet Laban for dream for nite kon tell am, “Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.”
So Laban tell Jakob, “Wetin make yu just deceive mi kon karry my dotas dey go like pipol wey dem katch with swod?
Afta e don komot from Paddan Aram, Jakob kon rish Shekem town wey dey for Kanaan and e stay near di town.
Na faith make am stay as strenja for di land wey God promise am. Na inside tent en, Isaak and Jakob wey go inherit di same promise, stay.