23 e take en men with am kon porshu Jakob for seven days. E katch am for di hill kountries for Gilead.
Abram kon tell Lot, “Make mi and yu nor kworel and make awa men nor kworel too, bikos wi bi brodas.
E kon sey, “Make praiz bi God own, my oga Abraham God, bikos Yu don show mi yor love wey nor dey fail and as Yu dey good to my oga family.”
Wen dem tell Laban for di third day sey Jakob don run,
But God kom meet Laban for dream for nite kon tell am, “Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.”
Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin.
Wen e kom outside di next day, e si two Hibru men dey fight. So e kon tell di one wey do bad sey, “Wetin make yu dey beat yor broda like dat.”