2 So Jakob kon si sey Laban nor dey do as e dey do with am before.
But Laban sey, “If really sey I dey good to yu, den yu go stay with mi, bikos my spirit tell mi sey, God bless mi, bikos of yu.”
Jakob kon hear sey, Laban shidren dey sey, “Jakob don take evritin wey bi awa papa own and naw, e don get money well-well.”
Den God tell Jakob, “Make yu go back to yor papa and yor family and I go dey with yu.”
and e tell dem, “E klear sey una papa nor like mi again. But di God wey bi my papa God always dey with mi.
but E nor like Kain and en ofrin. So Kain kon dey vex and e face kon shange.
Den Moses tell God, “My Oga God, Yu know sey I nor sabi tok well since dem born mi kon rish naw wey Yu dey tok to mi, yor savant.”
King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.
If pesin kill anoda pesin by mistake, without sey dem kworel or dey fight before, di pesin fit run go any of di town go stay.
Di man among una wey kwayet pass, go turn kon attack en broda, en wife and en shidren wey remain.
Den Jonatan bring David kon meet Saul and di boy kon dey serve am as e dey do before.