16 All di money and propaty wey God don take from awa papa hand, na wi and awa shidren get dem.”
So dat day, Laban komot all di animals wey get white spot, mark or wey black kon sey make en pikin kare for dem.
E nor dey trit us like strenjas naw? Bikos e don sell us and e don really chop di money.
So Jakob kon put en wife and shidren on-top kamel.
Like dis, God don give mi many of una papa animals.
Di present na two hundred woman goat, twenty man goat, two hundred iyu, twenty ram,
All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far.