Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 31:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Jakob kon hear sey, Laban shidren dey sey, “Jakob don take evritin wey bi awa papa own and naw, e don get money well-well.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 31:1
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Like dis, Jakob kon get money, animals, both man and woman savant, kamel, donkey and plenty propaty.


So Jakob kon si sey Laban nor dey do as e dey do with am before.


Den Laban ansa Jakob, “Di girls na my pikin, di shidren na my shidren, di animals na my animals and evritin wey yu dey si so, na my own. But wetin go make mi ponish my dotas and di shidren wey dem born?


So make una tell my papa about all my honor for Egypt and about evritin wey una dey si so. But make una kwik bring my papa kom meet mi for here!”


E kon dey boast give dem sey e get money well-well; many sons; how di king don promote am and how e dey important to di king pass any oda offisa.


My savants neva ever sey, ‘Awa oga let hunga kill some pipol.’


My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.


Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.


Wen peace dey yor heart, e go give yor body life; but jealousy bi like diziz for pesin bone.


Vexnashon bad and anga dey distroy tins, but who fit stand and bear jealousy?


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


Deat go open en mout wide dey wait dem and all di big and betta pipol with doz wey dey celebrate for Jerusalem, go soon enter deat mout.


God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.


God sey, “Jerusalem, pipol go use dis tins take tok about yu: ‘Like mama, like pikin.’


Den devil take Jesus go one mountin wey high well-well kon show am all di kingdom for dis world and all di betta tins inside am.


dat pesin dey proud and na only to dey argue and kworel, e know. Dis kind tin nor good, bikos jealousy; kworel; lie-lie; to dey suspet odas anyhow


Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.


Human being bi like grass and wetin make am fine, bi like flower; di grass go dry and di flower go die,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ