So Sarai kon tell Abram, “Since God neva let mi born shidren, make yu sleep with my savant. May bi wi fit from der get awa own family.” Abram kon do as Sarai tok.
Wen Israel king read di leta, e tear en klot kon sey, “Na mi bi God wey get pawa to give and take life? Wetin make di king tink sey I go fit cure dis man? If yu tink am well-well, yu go si sey e dey find as e go take fight mi.”
Wen Moses waka near di kamp kon si di melu and di way di pipol dey dance, e vex well-well. E trowey di stones wey dey en hand and dem kon break to pieces.
But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.