16 God kon tell di woman, “Wen yu dey labor, I go make am pain yu well-well. Na inside pain yu go take born shidren. Yu go won kontrol yor husband, but na-im go bi yor head.”
“Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”
E get one man wey dem dey respet well-well among en brodas and en name na Jabez. En mama koll am Jabez (wey mean pain) bikos e sey, “I sofa well-well wen I won born yu.”
But wen e si all di good tins wey en sofa bring, belle go sweet am. My savant wey I like well-well, go bear plenty pipol ponishment and I go forgive dem bikos of am.
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
Wen woman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en time to born don rish, but wen e don born, e go happy and e nor go remember di pain again, bikos e go si sey e don born pikin.
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.
to dey kontrol diasef; get pure mind; dey do dia house work well; dey kare for pipol; dey do as dia husband wont, so dat pipol nor go tok anyhow about God word wey wi dey prish so.