Den di pipol si di tonda and di lite. Dem hear di horn sound kon si di mountin wey smoke kover and wen di pipol si all dis tins, fear katch dem, so dem kon waka far from di place.
But naw, why wi go won die again? Bikos if di Oga awa God tok to us again, den wi go really die! If wi kontinue to dey hear awa Oga God vois, wi go die!