35 Leah still get belle again and e born anoda boy. E kon sey, “Dis time I go praiz God.” Dat na why e koll am Judah. Den Leah nor kon born again.
Wen Leah si sey e nor fit born again, e kon give en savant Zilpah to Jakob.
Di sons wey Zilpah, Leah savant born na Gad and Asher. All dis na Jakob sons wey dem born for am for Paddan Aram.
Judah sons na: Er, Onan, Shelah, Perez and Zera (But Er and Onan die for Kanaan land). Perez sons na Hezron and Hamul.
Bikos na Judah strong pass, dem kon make am leader among en brodas, but na Josef dem still take as first pikin.
For Reuben boundary for east go rish west, Judah tribe go get one part.
Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born;
Abraham born Isaak, Isaak kon born Jakob. Na Jakob born Judah and en brodas,
Moses pray for Judah tribe sey: “My God, make Yu hear Judah pipol kry kon bring dem togeda as one. Make Yu give dem pawa to take fight and win dia enemies!”