Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 29:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 Leah get belle again kon born anoda boy. E kon sey, “Bikos God hear sey my husband nor love mi, E don give mi dis one too.” So Leah kon koll am Simeon.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 29:33
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Leah sey, “God don give mi my reward, bikos I give my savant to my husband make e sleep with am.” So e koll am Issakar.


Den Leah sey, “God don give mi betta gift. Naw, my husband go honor mi, bikos I don born six boys for am.” So e kon am Zebulun.


Den Rashel sey, “God don save mi. E don ansa my prayers kon give mi boy pikin.” Dat na why Rashel koll di pikin Dan.


Den Rashel sey, “I don really fight betta fight with Leah, my sista and I don win.” So e koll di pikin Naftali.


So for di third day, wen all of dem still get sore, two among Jakob sons, Simeon and Levi, Dinah brodas, take swod go fight di town kon kill all di men.


Den Jakob tell Simeon and Levi sey, “Una don turn mi to dirty wey dey smell to di pipol for dis land, Kanaan pipol and Periz pipol, bikos of di wahala wey una put for my head. My pipol nor plenty and if dem gada demsef kon attack mi, dem go distroy both mi and my family.”


Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.


So Josef turn from dem kon dey kry. Wen e turn face dem again, e kon sey make dem go put Simeon for prison as all of dem dey look.


From Benjamin boundary for east go rish di west, Simeon tribe go get one part.


from Simeon tribe, e pick Shemuel wey Ammihud born;


If man get two wife and e love won pass di oda, den di two wife born boy pikin, If di first-born na from di wife wey e nor love,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ