Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 29:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 So Jakob kon dey travel until e rish di land where pipol dey for east.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 29:1
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di savant take ten kamel from en oga own kon go with difren gifts from en oga, just as e wont. E travel go Aram Naharaim aria for Nahor town.


Wen Isaak na forty years, e kon marry Rebekah wey bi Betuel, di Aramean pikin and dis Betuel kom from Paddan Aram. Rebekah broda na Laban di Aramean.


But wen Abraham still dey alive, e give gift to di shidren wey en oda wifes born for am kon send dem go east, so dat dem go dey fast and nor disturb Isaak.


Den God tell Jakob, “Make yu go Bethel go stay. Make yu build one altar for God for where E for appear to yu wen yu dey run from Esau yor broda.”


E build one altar for der kon koll am El Bethel (wey mean God house), bikos na for der God for show ensef to am wen e dey run from en broda.


Solomon get sense pass di wise men for east and for Egypt.


I go run follow yor kommands, bikos Yu dey make mi undastand life well-well.


So, I go kwik-kwik dey do wetin Yu kommand.


So, make wi kontinue to chop with joy and drink with happiness for awa heart, bikos God don already asept awa work.


Jakob run go Aram land. For der, e kare for sheep, to take pay for en wife.


Den Balaam profesai kon sey: “King Balak for Moab bring mi kom from Aram, from di mountin wey dey di east kon sey, ‘Make yu kom help mi curse Israel pipol.’


Anytime wen Israel pipol plant, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert go kon attack dem.


Leta, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert gada togeda kon cross Jordan River go kamp for Jezrel Valley.


Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.


By dat time, Zebah and Zalmunna and dia soja, dey Karkor. Dem bi only 15,000 wey remain from all di men wey dey di desert tribe and dem don kill 120,000 of dia soja.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ