9 Go where di animals dey kon kill one of di goats. I go prepare dem make e sweet well-well as yor papa dey like am.
Den yu go take am go give yor papa. E go chop am kon bless yu before e die.”
So Jakob take di goat go give en mama. Di woman kon kook some sweet food, just as Isaak dey like am.
Make yu prepare betta food for mi, di kind one wey yu know sey I love, den bring am kom meet mi. Den I go chop kon bless yu before I die.”
Naw, my pikin, make yu do as I tell yu!
Den Manoah tell God angel, “Abeg stay here make wi kill and kook one small goat make yu chop.”
So Jesse load one donkey with bread, one kontaina wey get wine and one goat kon send dem with en pikin David, go meet Saul.