Pipol go serve yu and nashons go bow to yu. Na yu go bi oga ova yor broda and yor mama shidren go bow for yu. Anybody wey curse yu, curse go dey en head and blessing go follow doz wey bless yu.”
Esau too prepare sweet food won go give en papa. Esau kon tell en papa. “My papa, get up make yu chop some bush meat wey yor pikin kook, so dat yu go bless mi.”