21 Den Isaak tell Jakob, “My pikin, make yu kom near mi, so dat I go fit tosh yu kon know if yu really bi Esau.”
My papa fit tosh mi! Den e go tink sey I dey fool am and e go curse mi instead of am to bless mi.”
So Jakob waka go near en papa Isaak and Isaak tosh am kon sey, “Di vois bi like Jakob own, but di hand bi like Esau own.”
But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do.
I go give peace to evribody, both doz wey dey far and near! I go heal my pipol.
Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.