32 Dat day, Isaak savant kon tell Isaak about di well wey dem dig sey, “Wi don si wota.”
Den Isaak build one altar for der kon woship God. E put en tent for der and en savant kon dig anoda well.
Very early for di next morning, Isaak and King Abimelek kon make peace with each oda. Isaak kon escort dem and dem kon komot without wahala.
So Isaak koll di well Shibah; dat na why dem dey koll di town till today, Beersheba.
Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well.
Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.
“Wen yu ask for sometin, God go gi-am to yu; wen yu look for sometin, yu go si am and wen yu nok, di door go open for yu.