Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 26:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 26:28
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den promise with di Oga God name, di God for heaven and eart sey yu nor go allow my pikin marry one for doz local Kanaan wimen.


Yu go dey free from di swear if yu go meet my family and dem nor gri give di girl to yu. True-true, yu go dey free.’


So make yu kom make wi enter agriment; dat is yu and mi. And dat one go show sey wi don setol.”


En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta.


From dat time, Potifa make Josef as pesin wey go dey kare for evritin wey dey en house and God kon dey bless Potifa house. Bikos of Josef, God blessing dey for evritin wey e get, both for di house and for di field.


David pikin, Solomon kon make en kingdom strong well-well, bikos di Oga wey bi en God dey with am and E gi-am pawa.


E gada all Judah and Benjamin pipol, plus di pipol wey dey for Efraim, Manasseh and Simeon tribe wey dey with am. Many pipol from Israel kom stay der wen dem si sey di Oga God dey with am.


God tell Israel pipol sey, “Egypt, Sudan and doz tall pipol for Seba with evritin wey dem get, go bi una own. Dem go waka follow una with shains for dia leg; bow for una kon beg dey sey, ‘True-true, God dey with una and e nor get anybody wey bi like am. Yes! E nor get any oda god.’ ”


Doz wey bin dey opress una, dia sons go kom bow for una. All di pipol wey look down on una before, go kon woship una. Dem go koll una, ‘Oga God Town. Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’


Dem go know una as God priests wey bi en savant. Una go enjoy di nashon propaty. Den una go dey proud sey na una own.


Dem go know dem for all di nashons and anybody wey si dem, go know sey dis na pipol wey I bless.”


Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


Den God go tell una di sekret wey dey dia heart. Den dem go knee down kon tell God sey, “Wi don really bilive sey yu dey with dis pipol.”


Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”


Wen pipol won setol matter, dem dey swear with pesin wey big pass dem and di agriment wey dem make, dey end di matter.


God tell Joshua, “From today go, I go start to honor yu among Israel pipol, so dat dem go know sey I dey with yu, just as I dey with Moses.


Nahash dem wey bi Ammon pipol kon mash dey go fight Jabesh pipol. All di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Make wi make peace with una and wi go serve una.”


Wen Saul know sey God dey with David and en pikin Mikal love David well-well,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ