27 Isaak kon ask dem, “Wetin make una kom meet mi? Nor bi bikos una hate mi, naim make una porshu mi?”
E get many sheep and kattle and en savant many well-well, so Filistia pipol kon dey jealous am.
Den Abimelek kon tell Isaak, “Make yu komot from here go anoda place, bikos di pawa wey yu get, don strong pass awa own.”
Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu,
Josef send message go give en papa Jakob sey make en and all di pipol wey dey with am kom Egypt and dem bi seventy-five wey go.
But di man wey dey opress en broda kon sey, ‘Who give yu pawa to rule and judge us?
“Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush.
Jakob shidren wey bi awa grand-grand papa dem, bikos dem dey jealous Josef dia broda, dem kon sell am as slave go Egypt, but God dey with am
Listin! Doz pipol from Satan sinagog wey lie sey dem bi Jew, I go make dem bow for yor front, den dem go know sey I really love yu.
But Jeftah ansa, “Nor bi bikos una hate mi well-well, naim make una force mi komot from my papa house. Why una kom meet mi naw wen una dey trobol?”