25 Den Isaak build one altar for der kon woship God. E put en tent for der and en savant kon dig anoda well.
So Abram karry en tent kon go stay near Mamre oak wey dey Hebron and e build anoda altar for God for der.
Dis na di place where e for first build altar. So Abram kon woship God for der.
Wen dem rish di place where God tok about, Abraham kon build altar for der and e arrange di wood on-top. Den e tie Isaak hand and leg kon put am on-top di altar.
Dat day, Isaak savant kon tell Isaak about di well wey dem dig sey, “Wi don si wota.”
For der, e build one altar kon name am, “Na Israel God bi God.”
Den God tell Jakob, “Make yu go Bethel go stay. Make yu build one altar for God for where E for appear to yu wen yu dey run from Esau yor broda.”
Seth too kon born boy and en name na Enosh. From dat time, pipol kon start to woship Oga God.
Noah build one altar for Oga God. E kon take some from evry klean animal and bird take offa ofrin for di altar.
So I go tank God with sakrifice kon pray to am.
So Moses build one altar kon koll am, “Na di Oga God bi my banner,”