So very early for di next day, Abraham take some food and wota kon give Hagar. E put di food for Hagar shoulder, gi-am en pikin kon sey make dem dey go. So dem go kon dey waka anyhow for Beersheba wildaness.
Make una nor go Beersheba go woship. Make una nor find mi go Bethel, bikos Bethel nor mean anytin again. Make una nor go Gilgal, bikos dem go soon karry en pipol as slave go anoda land and Bethel go turn empty land.”
Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa.