20 di men for Gerar kworel with Isaak men kon dey sey, “Na wi get di wota!” So Isaak koll di well Esek, bikos dem follow am drag am.
So Abram men and Lot men wey dey look afta dia animals kon bigin kworel. (For dat time, na Kanaan and Periz pipol dey stay for di land.)
But Abraham kon tell Abimelek about di well wey one of en savant seize.
Wen Isaak savant dig for di valley kon si well wey get fresh wota,
En savants dig anoda well, but dem still follow am drag am too, so Isaak koll di well, Sitnah.
Den make una tell am sey, ‘Yor savants dey kare for animals since wi bi small pikin kon rish naw, both wi and awa papa.’ Make una tok like dat, so dat una go fit stay for Goshen land, bikos Egypt pipol nor like pipol wey dey kare for animals.”