19 Wen Isaak savant dig for di valley kon si well wey get fresh wota,
Isaak kon open di well again wey en papa Abraham dig wey Filistia pipol kover afta Abraham don die. Isaak give dis well di same name wey en papa gi-am before.
di men for Gerar kworel with Isaak men kon dey sey, “Na wi get di wota!” So Isaak koll di well Esek, bikos dem follow am drag am.
Yu bi gardin wey get fountain; well wey get fresh wota wey dey kom down from Mount Lebanon.
Di pesin wey bilive mi and wetin I tok, make e kom drink, just as God word sey, ‘Plenty wota wey dey give life, go flow from inside en belle.’ ”