Hadad and di men wey karry am run kon from Midian go Paran, where oda men for join dem. Den, dem travel go Egypt and Egypt king kon give Hadad some land, house and food.
Job three friends hear wetin dey happen to am, so dem kon sey dem go-go greet am. Dia names na Elifaz from Teman, Bildad from Shuh and Zofar from Naamah.
Den Moab pipol tell di eldas for Midian sey, “Dis plenty pipol go kon distroy evritin wey wi get, just as melu take dey chop grass for field.” Naw, King Balak wey Zippor born wey dey rule Moab pipol for dat time