19 Dis na di story about Abraham pikin Isaak. Abraham na Isaak papa.
Abraham koll di pikin wey Sarah born, Isaak.
Wen Isaak na forty years, e kon marry Rebekah wey bi Betuel, di Aramean pikin and dis Betuel kom from Paddan Aram. Rebekah broda na Laban di Aramean.
Abraham born two sons: Isaak and Ishmael.
Keturah wey bi Abraham girl-friend, na-im born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak and Shuah. Na Jokshan born Sheba and Dedan.
Na Abraham bi Isaak papa. Isaak shidren na: Esau and Jakob (wey God shange en name to Israel).
Abraham born Isaak, Isaak kon born Jakob. Na Jakob born Judah and en brodas,
Jakob wey Isaak born, naim bi Judah papa. Abraham born Isaak and na Terah wey Nahor born, bi Abraham papa.
So God make kovenant with Abraham thru sekonsishon. Abraham kon born Isaak and sekonsaiz am afta eight days. Isaak born Jakob and Jakob born di twelf brodas, wey bi awa grand-grand papa dem.