63 As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom.
Abraham look and e si three men stand for di oda side. Wen e si dem, e run go meet dem kon bow for dem.
Wen Rebekah look, e kon si Isaak. E kom down from en kamel
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
Make wetin I dey tink, make belle sweet am and I go rijoice bikos of my God.
I go learn yor kommand kon study yor laws.
Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do.
I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws.
I go always dey tink of yor majesty, yor wonderful works and all yor mirakles wey yu do.
Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.