Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 24:42 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

42 “Wen I rish di well today, I kon pray sey, ‘My Oga wey bi my oga Abraham God, if Yu know sey Yu go make my journey well, make evritin happen as dem suppose bi.’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 24:42
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E make di kamel knee down near di well wey dey outside di town. Dat na evening time wen di wimen dey kom fetch wota.


E kon sey, “Make praiz bi God own, my oga Abraham God, bikos Yu don show mi yor love wey nor dey fail and as Yu dey good to my oga family.”


“Make yu kom stay with us, bikos God don bless yu! Wetin make yu stand for outside di town wen I get room for yu and I go fit prepare somewhere for yor kamels?”


En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta.


For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.


Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.


Make yu kommit evritin wey yu dey do for God hand. Trust am and E go help yu.


Make di Oga awa God show us en favor, den evritin wey wi dey do, go prosper. Yes! Make Yu allow evritin wey wi dey do, prosper!


Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”


and I always dey pray dey ask God if E go let mi kom si una again.


Naw, Hannah dey pray from en heart. Aldo en lips dey move, but dem nor dey hear en vois. So Eli kon feel sey Hannah don drink well-well.


But di savant ansa, “Si, one God savant dey dis town wey evribody dey respet. Evritin wey e tok really dey happen. So make wi go der, may bi e fit tell us wetin wi go do.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ