28 Di girl kon run go house go tell en family evritin wey happen.
Naw, Rebekah get one broda wey en name na Laban and e run go meet di man for di well.
“Den I bow woship God wey bi my oga Abraham God, bikos na-im lead mi for di korrect way, so dat I go meet my oga Abraham broda Nahor grand-pikin.
But Rebekah broda and mama kon ansa, “Make di girl still stay with us for like ten days, den e fit kom meet una.”
Den Isaak take Rebekah enter en mama room. E take am as en wife kon love am. So, Rebekah make Isaak mind rest, afta en mama don die.
Wen Jakob tell Rashel sey e rilate to en family and na Rebekah, Laban sista bi en mama, Rashel run go tell en papa.
So Laban enter Jakob room and Leah room with di two savant own, but e nor si anytin. Den e komot from Leah room kon enter Rashel own.