Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 23:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 “Okay my oga! I go sell both di field and di grave give yu. For my pipol front, I sell am give yu. Make yu go beri yor wife for der.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 23:11
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and all dem kon bi en propaty. So Het shidren and evribody wey dey enter di gate for Efron town kon bi en witness.


“Oga, make yu listin to us. Yu bi prince wey get betta pawa among us! Yu fit beri yor wife for di best land wey wi get for here. All of us go happy to give yu land make yu beri yor wife put.”


But good pesin dey plan to do good tins and na-im karata dey save am.


“ ‘Anybody wey dem akuiz sey e kill pesin go dey guilty, dem go fit kill-am, if two or more pipol bear witness sey na true. But if na only one pesin tok against am, den dat one nor rish to kill-am.


“Den di oga tell di oda savants, ‘Make una take di money from am, gi-am to di savant wey get ten.’


But make una nor ever kill pesin, bikos of wetin one pesin tok. Two or three pesin must tok di same tin, before una go fit stone pesin die.


Make una nor hold anybody sey e do bad, if na only one pesin bi witness. Di trut for di matter bi sey, two or three pesin must sey dem si wetin happen.


Naw, Boaz kon go sidan for di village gate. Wen di relashon wey dey klose to Elimelek dey waka pass; di man wey e tell Rut about, Boaz kon tell am. “My friend, abeg kom sidan for here, bikos I wont tok with yu!” So, e kon sidan.


Den all di eldas wey dey di gate kon sey, “Yes! Wi bi witness. Make God make yor wife bi like Rashel and Leah, wey born many pikin for Jakob. Make yu get plenty money for Efrat and evribody go know yu for Betlehem.


E good make yu know about am. So if yu wont am, make yu buy am for di leaders present wey sidan here. But if yu nor wont am, make yu tok, bikos na yu get rite to buy first, before mi.” Den di man sey, “I go buy am.”


Den Boaz tell di leaders and evribody wey dey der, “All of una na witness sey, ‘Today I don buy from Naomi, evritin wey bilong to Elimelek and en shidren, Kilion and Mahlon.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ