1 Sarah stay for one hundred and twenty-seven years.
Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?”
En savant Reumah still born shidren for am and dia names na: Tebah, Gaham, Tahash and Maaka.
E die for Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw) for Kanaan land. Abraham mourn and kry for Sarah.
Den Isaak take Rebekah enter en mama room. E take am as en wife kon love am. So, Rebekah make Isaak mind rest, afta en mama don die.