20 Afta all dis tins, dem kon tell Abraham sey, “Milka sef don born shidren for yor broda Nahor
Wen Terah na seventy years, e kon born Abram, Nahor and Haran.
Dis na Terah shidren-shidren. Terah born Abram, Nahor and Haran. And na Haran bi Lot papa.
Abram and Nahor kon marry wife. Abram wife name na Sarai and Nahor wife name na Milka wey bi Haran pikin and Haran na still Iskah papa too.
Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”
and na Uz bi first-born, en brodas na Buz, Kemuel (Aram papa),
Den di savant take ten kamel from en oga own kon go with difren gifts from en oga, just as e wont. E travel go Aram Naharaim aria for Nahor town.
Before e pray finish, Rebekah kon dey kom with en wota pot for en shoulder. E bi Betuel pikin and en grand-mama na Milka (Milka na Abraham broda wife, Nahor).
Rebekah ansa, “I bi Betuel pikin and na Milka and Nahor born Betuel.
Abraham and Nahor God, dia grand-papa God go judge between yu and mi.” So Jakob kon swear with di God wey en papa Isaak dey fear
To hear good news from land wey far, bi like wen pesin pour kold wota or drink for en body.