6 Den for di dream, God ansa am, “Yes, I know sey wetin yu do na with betta mind. Dat na di rizin wey make mi nor let yu sin against mi or tosh di woman.
Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”
Bikos una dey kom meet mi di Oga una God three times evry year, I go drive di pipol for doz kountry wey won stop una and I go make una land big; so dat nobody go fit take una land.
As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”
“Naw my oga, as long as God dey alive and as long as yu dey alive too, God nor go let yu kill or do tins di way yu wont am. Naw, make yor enemies and doz wey dey try to wound yu, bi like Nabal.
If not, as long as di Oga wey bi Israel God dey alive, di pesin wey stop mi to kill una, if to sey yu nor kwik meet mi, by tumoro morning, no singol boy for Nabal family for dey alive.”