Di angel kon sey, “Make yu nor do di boy anytin, nor wound am. Naw! I don know sey yu dey fear God, bikos yu even ready to kill yor only pikin for mi.”
Wen di men for di place ask am about en wife, e kon tell dem sey, “Na my sista.” Fear nor fit let am sey, “Na my wife,” bikos e tink for en mind sey, “If I sey na my wife, di men for dis place go kill mi make dem for fit get Rebekah, bikos e too fine.”
All di govnors wey don rule before mi, trobol di pipol and dey kollect forty silva koins evriday for food and wine. Even dia savants dey opress di pipol too. But I difren from dem, bikos I dey fear God.