Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 2:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 God make Eden Gardin for di east kon put di man wey E kreate for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 2:8
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Lot look well-well from Jordan River aria go rish Zoar. E kon know sey evriwhere for der get betta green plant and dem get betta wota like Oga God gardin for Egypt. (Dis na before God distroy Sodom and Gomorrah.)


So Oga God kon porshu man and en wife komot from Eden Gardin, so dat e go-go farm for di groun where God from kreate am.


Wen God porshu dem komot, E kon put angels for di gate for di east side for di gardin with one swod wey dey bring fire and e dey turn face evriwhere. Dis one na to stop anybody wey won go near di tree wey dey give life.


So Kain komot from di Oga God front kon go stay Nod land wey dey di east side for Eden.


Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem?


I go sorry for Jerusalem and evribody wey dey stay di land wey dem skata. Even doh en land na desert, I go turn am to gardin and e go bi like Eden gardin. Joy and happiness go dey der and dem go sing songs take praiz and tank mi.


Haran, Kanneh and Eden town; di sojas for Sheba, Asshur and Kilmad town; all of dem dey buy and sell with una.


Yu dey stay for Eden, God gardin. Dem kover yu with fine stones like rubis, diamonds, topaz, beryl, karnelian, jasper, safayas, emeralds and turkwoise. Na gold dem take make evritin about yu and dem make all dis tins for yu for di day wey God kreate yu.


Wen I send am go where dead body dey, nois wey e go make wen e fall, go shake di whole world. All di trees for Eden and di betta wota for Lebanon wey dey under di world, go happy wen e fall.


Na Egypt king and en pipol bi di tree. E get any tree for Eden wey tall and fine like una? But naw, like di trees for Eden, una go die kon join wiked pipol and doz wey dem kill for war. Dis na wetin Oga God tok.’ ”


Dem go distroy evritin wey dem si like sey na fire burn dem. For dia front, di land bi like Eden Gardin, but wen dem don pass, e go bi like desert for dia back. Dem go distroy evritin finish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ