Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 2:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Di man and en wife nor wear anytin for body, but shame nor katch dem at-all.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 2:25
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den dem two eye kon open and dem kon know sey dem nor wear anytin; so dem sew fig leaf togeda kon take am kover dia body.


Nobody wey trust Yu dey si disgrace, but disgrace na for doz wey dey try to deceive odas.


My God, nor let dem disgrace mi, bikos I dey koll make Yu kom help mi. Instead, make disgrace follow wiked pipol and make dem die go dia grave, where dem go dey silent forever.


Moses si sey bikos of Aaron, di pipol nor fit kontrol diasef again and dia enemies dey laf dem.


“Pipol wey dey make juju nor mean anytin and di juju wey dem tink sey dey give dem happiness, nor mean anytin at-all. Di pipol wey dey serve di juju nor dey si and dem nor know anytin; so na shame and disgrace go follow dem.


Pipol go si yor nakednes and shame go katch yu well-well, bikos I go revensh and I nor go sorry for yu.”


Make una nor fear, dem nor go disgrace una again. Make una nor fear at-all, bikos una nor go face shame again. Una go forget una shame wey happen wen una dey small and una nor go remember di sofa wey una sofa wen una nor get shidren.


Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”


Shame dey katch dem bikos of di wiked tins wey dem do? No! Dem nor dey shame at-all. Dem nor even sabi form sef! So, dem go die just as odas die. Dem go die finish, afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.


Yu go remember how yu bihave, den shame go katch yu wen yor senior and yonga sista go kom back kon meet yu. I go let dem bi like yor pikin.


Una go get plenty food to chop kon beleful. Una go praiz di Oga una God wey don do many wonderful tins for una and nobody go laf my pipol again.


If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”


Anybody wey dey shame for mi and my word, Man Pikin go shame for am wen e go kom back for en glory and di glory wey en Papa and di angels get.


Bikos God word sey, “Anybody wey bilive am, nor go shame.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ