13 Di sekond river name na Gihon; e dey flow pass Kush land.
Ham shidren na Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
Kush na Nimrod papa, dis Nimrod kom bi warrior for di eart.
Di first river name na Pishon; e dey flow for Havilah land, di place where gold dey.
(Di gold wey dey di land, dey pure and difren-difren good iron still dey der too.)
Di third river name na Tigris; e dey flow pass di east for Assyria. And di fourt one name, na Eufrates.
Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.