Di one wey bad pass bi sey, e get some wimen wey dey do ashawo work for doz place wey dem for dey serve juju. Judah pipol do tins wey dey make pesin shame, just as di pipol wey God drive komot for di land before, dey do.
Dia face dey show sey dem dey guilty. Just like di pipol for Sodom, na so too dem dey boast about dia sin. E bad well-well for dem, bikos dem dey distroy demsef.
Shame dey katch dem bikos of di wiked tins wey dem do? No! Dem nor dey shame at-all. Dem nor even sabi form sef! So, dem go die just as odas die. Dem go die finish, afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.
“Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.
Samaria nor do half of di bads tins wey yu do. Yu ways bad well-well pass dia own. Bikos of di bad tins wey yu dey do, e kon bi like sey yor sistas nor even do any bad tin at-all.
If man sleep with man like sey e dey sleep with woman, both of dem don kommit bad sin. So dem must kill two of dem and dia blood go dey for dia own head.
Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;
Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings
Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.
As dem dey chop and drink, some pipol wey dey kause trobol for di town kon surround di house. Dem bigin nok di door dey shaut for di old man, “Make yu bring di man wey dey stay with yu, so dat wi go sleep with am.”