Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”
But wen una don near Ammon pipol, make una nor let dem vex won kon fight una, bikos I nor go give una any of dia land; bikos I don already gi-am to Lot shidren-shidren.
Den God tell mi, “Make una nor let Moab pipol wey bi Lot shidren-shidren vex. Make una nor kause wetin go make dem won fight una, bikos I nor go give una any of dia land, bikos I don give Ar to Lot shidren-shidren.
Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.
Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.