Si, I get two dotas wey neva sleep with man before. Make I give dem to una and una if do dem anytin wey una like. But make una nor do anytin to dis men, bikos na my house dem dey.”
Den God tell mi, “Make una nor let Moab pipol wey bi Lot shidren-shidren vex. Make una nor kause wetin go make dem won fight una, bikos I nor go give una any of dia land, bikos I don give Ar to Lot shidren-shidren.
So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.
Samuel kon sey, “Just as yor swod kill pipol shidren kon make some wimen nor get pikin again, na so yor mama nor go ever get pikin again.” Den Samuel kut Agag to pieces for God present for Gilgal.