Jenesis 19:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
31 Di senior dota kon tell en sista, “Si! Awa papa don dey old and e nor get anybody for di whole world wey go marry and sleep with us, so dat wi go get shidren.
So Sarai kon tell Abram, “Since God neva let mi born shidren, make yu sleep with my savant. May bi wi fit from der get awa own family.” Abram kon do as Sarai tok.
Before-before and even leta, Nefilim pipol (giant pipol) dey for di eart and na God sons born dem wen dem dey sleep with ordinary wimen. Na dem bi di wariors wey pipol bin know for evriwhere.
For di last days, seven wimen go hold one man kon sey, “Wi go feed and buy klot for awasef, but make yu just let us koll yu awa husband, so dat pipol nor go laf us, bikos wi nor get husband.”
If two brodas dey stay togeda and one die and e nor get boy pikin, di wife wey en husband don die must nor marry anoda man wey nor dey dat family. Instead, di woman husband broda go marry am kon kare for am.