For morning, di angel kon tell Lot, “Make una dey go! Lot! Karry yor wife and shidren komot kwik-kwik, if not, wen God dey judge di town, dem go distroy una join!”
God pass en front kon sey, “Na mi bi Oga God. I bi God wey get mesi and pity; I nor dey kwik vex; just as I big na so too my love big rish and I nor dey fail.
I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”
‘Mi wey bi God, I nor dey kwik vex and I dey show my love and goodness well-well. I dey forgive pipol sins and sturbones, but I go still ponish dia shidren-shidren go rish dia third and fourt generashon, bikos of di sin wey dia papa and mama kommit.’
But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt.
E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.
Joshua kon tell di two men wey kon spy di land before sey, “Make una go di ashawo house den bring en and evribody wey dey di house kom out, just as una promise am.”